JOKES:TOO MUCH GRAMMAR DEY CAUSE TROUBLE O...
I enter this Cross- Country bus from Abuja to
Benin yesterday.
As we dey go for road one man for back say
'driver I am impressed.' The driver com say 'thank you sir.'
We never reach Lokoja wen the man tell
driver again, 'driver I am impressed.'
The
driver come thank the man again.
Before we comot for Lokoja the man don
thunder again say, 'driver I am impressed.' The driver come say,
'thank you very much
sir, I very much appreciate your
compliments.'
The driver begin dey fire the bus dey go
come dey feel like James Bond.
As we reach Okene the man shout 'driver stop this bus, stop this
bus, you mad, you
wan kill person?'
As driver stop the bus the man run comot
like Usain Bolt enter bush.
We rush follow the man make we see wetin
dey impress the man. Before we reach where the man dey we hear
pra pra pratata pro pro!
Na there we come realise say wetin the man
wan tell driver be, 'driver I am pressed'
I take God beg all of una....... If the English
hard small, una fit talk am for pidgin. Meanwhile... I' m impressed
right now, make
I rush discharge... I dey come
0 Comments:
Post a Comment
Subscribe to Post Comments [Atom]
<< Home